Sunday 23 October 2016

una welcome to to anoda episode of "splensizy Aproko Daily Recap" on the news today ,is your favorite boy,no 1 splensizy aproko aka




 Don jazzy accountant,aka cuteboi aka rugged guy

Our headlines today na:

1.i don show una waiting i get 4 times since 1974

2.civil servants lazy n dem dey corrupt-president buhari

3.Govanors n ministers must show waitin dem get-pres. buhari

4.dem don talk say any kidnappers wey dem catch na to kpof am 4 cross
river


5.shuuuuu! woman born slippers for bauchi


oya d tori in full

1.i don show una waiting i get 4 times since 1974


our presido dey talk on monday for accra,Ghana as him dey tell all dis news
people say him don tell us waitin him get four times since 1975
n him dey even challange d newsmen say make dem go shine deir eye
well for waitin him get..
him even dey tell d news people say make dem use d law dey dey ground take
find out about waiting him get..
he talk say "i remember dat year [1975]wey late Murtala mohammed na head of
state, dem tell us make we line up dey for corridor- both governors,ministers,
members of supreme military council and both d ogas of justice all of us
show n talk waiting we get one by one
so from now both governors,ministers,permanent secretaries must show us waitin dem get..

for d full tori incase u wan hear waitin he talk again make u press here
_______________________________________________________________________________


2.civil servants lazy n dem dey corrupt-president buhari

lolzzz una see as him do him mouth for d foto wey dey up??na him make am i like d man
dis go show una say him no get tyme o n him no dey look anybody face
oya make i yan una d tori.......
our presido as una know wen him name na presido muhammadu buhari
talk say the civil service get hand for d low productivity and d corruption
wey dey we 9ja..
buhari, wey him vice represent prof. yemi osinbanjo for the party
wey dem host for d capacity building programme wey dem name "structured
mandatory Assessment based Training programme and leadership enhancement
and development programme" wey dem do becos of public servants
make una read d full tori here o omo him grammar too much

________________________________________________________________________________

3.Govanors n ministers must show waitin dem get-pres. buhari

presido don talk say both Governors, ministers and top civil servant must show n talk
waiting dem get..
the presido wey tell us waiting him get lastweek don challenge dem for ghana yesterday
where him go do one day work as him reach deir presido crib
make una read full tori here

_________________________________________________________________________________

4.dem don talk say any kidnappers wey dem catch na to kpof am 4 cross
river


the cross river state Goernor prof ben ayade don sign am for law bill say
any kidnappers wey dem catch for the state na death dem go face..
this law wey him sign na one of d 10 laws wen him don sign for d state executive
chambers wey d speaker and d members for d state house of assembly, the chairmo
of {PDP} for d state and d secretary to d state government don witness....
for d complete tori make u press here

_________________________________________________________________________________


5.shuuuuu! woman born slippers for bauchi

according to waiting i hear say NTA report talk, dem say 25 years AMINA USMAN wey neva
get any qwata 4 belle say dem rush her go d Azare Generl hospital becos say shey
dey complain say something dey waka for here belle...as dem reach d hospital na so
d oga for d nurse dem give her medicine so dat d pain go reduce according to waiting
d oga for nurse still yan she say as small time go after dem don tell her say she fit
go na so him call am say she don born slippers...lolzzz i no fit laf..
make una no vex o d tin funny o......
oya make una see d video incase una tink say i dey lie
make u download d video for here
download video
na so we see am oo...







No comments:

Designed by Anyinature